TRENDING

Emeka Ike ex-wife reply, accuse di actor of violence during dia marriage





FAST DOWNLOAD



Nollywood actor Emeka Ike ex-wife Suzanne Emma don respond to di actor recent interview wia e tok about dia marital issues and how e end.

For di interview for Rubbing Minds wey air for Channels Television, di actor bin deny accusations of domestic violence during im marriage to Emma.

But Emma insist for one interview she do wit media personality Chude Jideonwo say she suffer domestic violence for he marriage.

She claim say she bin dey chop beating from her ex-husband during dia marriage as she give example of wetin she say happun wen dia sick pikin dey hospital.

“E get one time wey we bin go hospital becos my pikin sick. We no get moni so I come begin dey negotiate wit di hospital if dem go fit just treat my pikin and we go pay later,” Emma tok.

“Im (Emeka Ike) just enta begin shout say I be fool. I no sabi tins, who be dis pipo wey I no fit follow dem tok. I come begin dey vex for am so I enta di car. Immediately im (Emeka Ike) enta di car na so im blow me for face.”

Last week Sunday, Emeka Ike tok say im lose all im investment afta im marriage with im ex-wife Suzanne Emma crash for 2017.

Di revelation bin shock many Nigerians. Emeka Ike and Suzanne Emma get four pikin togada afta 17 years of marriage.

Suzzane Emma allege say afta ten years wey she bin don separate from Emeka Ike she decide to come grant interview becos im still dey abuse am ontop social media and she wan put an end to di abuse.

“I run commot from abusive relationship but I still dey under abuse for di past 10 years,” Emma tok.

She tok say dem meet for di first time wen she bin dey 18-year-old afta she finish secondary school anda allege say im bin no allow am work even though she get interest in acting career.

“Di abuse start as torture, financial abuse becos e bin no allow me to work, I wan become actress,” Emma tok.

Emma explain say she marry di actor wen she dey age 23 afta she born two pikin for am but she begin dey fight back at age 28 wen di abuse allegedly don become physical.

She also allege say di actor bin don beat am paralyze before but she still stay for her marriage two years afta before she decide to comot.

“I no see di signs as signs becos im bin my first boyfriend but wen I dey 28 years, I begin dey fight back so di abuse come escalate to physical.

Di last time wey im beat me I almost paralyze, na dat time I come decide say I go leave di marriage,” Emma tok.

“I get fotos, I present am during di divorce. I still get dem but I go only give am to di court.” Emma add.

Emeka wey come out publicly for one interview wit Rubbin’ Minds, Channels TV programme, tok say im marital issue wit ex-wife cause make im school business collapse, as im add say im no eva beat Emma.

“My secondary school, St Nicolas College for CMD road, Magodo, dey locked, ova N480m investment wey dem shut down dat year, and all I hear be say na constant battery.

“I dey always say, I neva beat dis lady, I go on air, call am, I say bae, I dey beat you?”

Di actor say pipo dey always manipulate mata if you be celebrity and na why dem no dey call carpenter or poor man woman beater.

“You go be veri successful man to be woman beater, becos no carpenter or poor man be woman beater.”

For anoda interview wit TVC on Friday, Emeka Ike tok say:

“I don move on but I dey try swallow evri tin but if I hear any stupid tok I go spill evri bean wey I don decide to hide,” Emeka Ike tok.

For 2017, Lagos Island Customary Court dissolve di marriage of Emeka Ike and im ex-wife Suzanne Emma.

Related Articles

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Back to top button