TRENDING

Police officer shoot Nollywood actor for neck during party





FAST DOWNLOAD



One trigger-happy police officer don shoot and injure one Nigerian Yoruba actor, Azeez Ijaduade for Ogun state.

Di incident happun on Saturday wen di officer shoot for air.

Di bullet hit di actor for neck afta di police officer open fire during Bramaj Company end of year party for Napoli hotel.

Di mobile police officer bin dey attached to one Chinese expatriate.

Wen e bin shoot into di air, di bullet go hit di actor.

One of di actor colleague, Abiodun Adebanjo for im Instagram page on Sunday morning confam am.

“Abeg we need help for Peru. Di police don shot my film director, Azeez Ijaduade, and im dey Babcock University Teaching Hospital,” Abiodun Adebanjo tok.

According to di update from Oga Adebanjo, im tok say dem don carry di actor go teaching hospital for Ilishan and im dey respond to treatment.

“We no need donation, We wan assure di world say im dey do well and evritin dey under control, if we need anytin we come come ask una,” Adebanjo tok.

Related Articles

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Back to top button